PODCAST · religion
AWR- Voice wen dey ginger Hope
by Adventist World Radio
AWR Pidgin English
-
295
-
294
Praise - God word wen we dey take grow
Hawa fess song say make we give Jesus all hawa wahala and de sekond song say God go fit do am again. Today message of Hope say God don tell us how we go take waka for dis life hinside wahala so make we hear watin God word dey tell us and do am
-
293
Woman dem mata - God word wen we dey take grow
Wen family manage deir girl pikin well well, dat girl pikin go come bi beta and happi woman tomorrow. Today message of Hope say wen we get beta fait and we no doubt God, we go get God blessing for hawa life yanfu-yanfu.
-
292
Pikin dem mata - God word wen we dey take grow
De tin wen pikin dem dey do as dem dey do exam wen bi crime naim bi today mata.Today message of Hope say fait for de last days na fait wen go do watin God want even wen watin God tork no sweet us for bodi
-
291
Pikin dem mata - God word wen we dey take grow
De tin wen pikin dem dey do as dem dey do exam wen bi crime naim bi today mata.Today message of Hope say fait for de last days na fait wen go do watin God want even wen watin God tork no sweet us for bodi
-
290
Praise - God word wen we dey take grow
Today fess sonb na de queshun wen dey ask weda God don take hin blood wash us and de sekond song say make we no let enitin dey bitwin us and God.De message of Hope say wen man and man dey sleep togeda as man and woman sorpose sleep, dat na abominashun
-
289
-
288
Praise - God word wen we dey take grow
Today fess son let us know say no bi bikos we good make Jesus save we and de sekond song say God love na ogbonge love. De message of Hope dey tell us say God give us de sabbat for rest and even wen we rish heaven we go still rest for de sabbat.
-
287
Woman dem mata - God word wen we dey take grow
Happi woman na woman wen get pawa to take do de tins dem wen e sorpose do as woman for hinsef and hin family. Today message of Hope say na Jesus naim die wen make us fit commot for devo hand and for sin and Jesus dey heaven dey pray for we.
-
286
Family mata - God word wen we dey take grow
Anoda tin wen man go see for de woman wen e want marray wen go let am know say na de woman be dat naim we go tork today. Today message of Hope say God give Israel rest wen dem come out of Egypt and God dey plan hawa rest wen Jesus come again.
-
285
Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take grow
De sikness wen dey let pesin belle dey do wan kain and wen pesin no go fit shit well naim we still put mout today. Today message of Hope tell us as God take save Israel commot for Egypt and e give dem hin law so dat dem go do watin e want
-
284
Pikin dem mata - God word wen we dey take grow
Watin examinashun bi and why for hawa life we musto dey do examinashun naim bi today mata. Today message of Hope say Abraham na pesin wen believe all de tin wen God tell am and dat one make am do watin God tork and God bless am
-
283
Family mata - God word wen we dey take growTiT
Vexnation wen pesin hold kakaraka for belle naim deyton to bitaness and bitaness fit scata marrage. Today message of Hope dey tell us say even for de time wen Noah dey life, God get plan wen e take save pipo bifor warta kill de odar pipo
-
282
Praya - God word wen we dey take grow
Today praya na for God to take moni bless hawa family, give pipo wen dey work promoshun and give hawa pikin dem work. De message of Hope dey tell us say God plan to save pipo dey ground bifor Adam and Eve sin sef so make we trust God.
-
281
Pikin dem mata - God word wen we dey take grow
De kain fashun wen dey for dress, shoe, bag, motor and plenti odar tin wen pipo dey take do fashun naim bi today mata. Today message of Hope say wen we give Jesus hawa life and de Holy Spirit come hinside hawa life, we go get new life.
-
280
Praise - God word wen we dey take grow
Today fess song say we happi as Jesus save us and de sekond song say make we let hawa lite shine for hawa korna De message of Hope say now when we don give Jesus hawa life, we sorpose waka as Jesus waka so dat pipo go see say we don save tru-tru.
-
279
Pikin dem mata - God word wen we dey take grow
De kain book dem wen hawa pikin dem sorpose read if dem wan get beta life naim bi deir mata today. Today message of Hope dey tell us why we need de savashun wen God don give us for hinside Jesus Chist.
-
278
Praise - God word wen we dey take grow
Today two song dem dey tell us say wen Jesus dey hawa life we go get peace wen only Jesus dey give hin pipo De message of Hope say Jesus peace na peace wen wahala no dey fit shake and na dat peace Jesus dey give hin pipo.
-
277
Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take grow
Shikin pos sikness and watin pesin go see for bodi wen e go take know say e get shikin pos naim bi today mata Today message of Hope say make we bi beta care taker for God eye bikos wen Jesus come e go ask us watin we take hin blessing do for am
-
276
Pikin dem mata - God word wen we dey take grow
To forgive pesin wen do you bad dey hard but God want make we forgive bikos wen we no forgive odar pipo den God sef no go fit forgive us. De message of Hope say we get new life for hinside Jesus and God want make we holy for hinside de new life.
-
275
Praise - God word wen we dey take grow
Today two song dey tell us say make we trust God bikos God no dey change and God know pass we. De message of Hope say make we no fear, make we no doubt God but make we believe bikos God na tork and do.
-
274
Woman dem mata - God word wen we dey take grow
De tin wen dey make some inlaw forlow deir pikin wife get wahala afta deir marrage naim bi today mata. Today message of Hope say God want make we hold hin word for hawa hat, make we believe and make we no dey give up bikos God na tork and do
-
273
Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take grow
De sikness wen konsign bad blood wen papa and mama dey give deir pikin and watin we go do to take manage de sikness naim bi today mata. Today message of Hope say God na tork and do and enitin wen God promise, God dey do am as e tork am.
-
272
Pikin dem mata - God word wen we dey take grow
Pikshure and film wen naked pipo dey and wen man and woman for de sleep togeda no bi sometin wen pikin sorpose put hin eye bikos e dey spoil mind. De message of Hope say God dey do watin e tork so make we read hawa bybbo to know God promise for hawa life
-
271
Praise - God word wen we dey take grow
Today fess song say Jesus na hawa gento shephad and de sekond song say we fit rest for God evalasting hand. De message of Hope say God dey protect hin pipo so dat notin go happun for dem and dat naim bi one way wen God take de care for hin pipo
-
270
Woman dem mata - God word wen we dey take grow
De kain tin wen inlaw dem especially moda in law dey do deir pikin wife naim bi today mata. Today message of Hope say God dey give hin pipo rest na watin make am give us de sabbat so day we no go work no rest
-
269
Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take grow
De kain tin wen vexnation fit do for pesin bodi and watin we go do wen we no go dey vex enihow naim bi today mata. Today message of Hope say wen e bi like say hawa life spoil and mata fall press us, God know how to take change hawa stori.
-
268
Pikin dem mata - God word wen we dey take grow
As beta pikin dem e go good make hawa pikin dem no dey put ear for de yeye music dem wen dey de world now. Today message of Hope say hawa God dey feed hin pipo as beta shephad dey take give hin sheep beta food and water.
-
267
Praya - God word wen we dey take grow
Today praya na for de gorvament and pipo for Kaduna, Kano and odar state dem make God epp dem make deir state beta. De message of Hope say na God bi hawa shephad and just like fulani dey carri deir cow go whey beta grass and water dey na so God dey do us.
-
266
Praise - God word wen we dey take grow
Today fess song na "Blessed bi de Lord" and de sekond song na "One tin naim I dey ask God: De message of Hope say de pipo wen God choose know de kain food wen God want make dem eat wen deir bodi go take well and dem dey try eat dat one
-
265
Woman dem mata - God word wen we dey take grow
Eni time pipo catch woman wen get husband dey forlow and sleep with anoda man, de wahala wen dey dat mata naim bi today mata. Today message of Hope say God make hin pipo caretaker for dis world and pesin wen spoil dis world, God go ansa am wen Jesus come
-
264
Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take grow
De kain tin wen dey happun wen fit make pesin kraze and how we go take manage krase pesin naim bi today mata. Today message of Hope say God pipo wen e choose know say na man and woman God make so dat dem go marray bon pikin make pipo full de world.
-
263
Pikin dem mata - God word wen we dey take grow
De kain friend wen we sorpose get na de friend wen resembo Jesus and wen go forlow us stand wen kata-kata bust. Today message of Hope dey tell us say God give us time and hin law for evrytin so make we no forlow eni pesin wen want change God time and law.
-
262
Praya - God word wen we dey take grow
Today praya na for de gorvament and pipo for Abuja, Adamawa, Bauchi and odar state dem make God give dem sense to take work well. De message of Hope dey tell us say God don choose us as hin pipo from de beginning and so make we waka as God pipo.
-
261
Praise - God word wen we dey take grow
Today fess song say Jesus naim bi hawa oga kpatakpata and de sekond song say Jesus dey come and e no go tay. De message of Hope say Jesus naim bi oga kpatakpata for dis world and for hawa life and naim get de name wen big pass
-
260
Woman dem mata - God word wen we dey take grow
Wen woman husband go forlow anoda woman dat na sometin wen de pain woman and e dey bring wahala come hin life. Today message of Hope say one big tin wen we musto know for Jesus na say Jesus get up from hin grave and so we sef go get up wen Jesus come
-
259
Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take grow
De sikness wen dey do woman wen just bon pikin and watin pipo fit do to epp de woman naim bi today mata. Today message of Hope tell us all de tin wen Jesus do to take save us and show us God love
-
258
Pikin dem mata - God word wen we dey take grow
If we make hawa bed as Joseph make hin bed for Bybbo, hawa life go beta bikos as you make yor bed na so you go sleep put. Today message of Hope dey tell us watin Jesus tish pipo wen make dem know Jesus and fit waka as Jesus waka.
-
257
Praya - God word wen we dey take grow
Today praya na for pipo for Niger and Edo state whey dis bandit dem for kill pipo and for de family of soja dem wen die. De message of Hope dey tell us who Jesus bi bikos na asd we know Jesus naim we go get de life wen no dey end.
-
256
Praise - God word wen we dey take grow
Today fess song na "New name in glory" and de sekond song na "Sanctify my heart" De message of Hope of Hope say beta kristian musto get Jesus kain mind bikos na de main dey show say we bi God pikin.
-
255
Woman dem mata - God word wen we dey take grow
Wen woman no get moni to take manage hin sef and do de tin wen e go like to do dat one dey put plenti wahala for de woman life Today message of Hope say if we get Jesus kain mind, we go bi pipo wan dey do watin God tork say make we do
-
254
Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take grow
De sikness wen dey make pikin bone soft so dat de bone fit bend or e brake and watin pesin fit do for dis sikness naim bi today mata. Today message of Hope say pesin wen get Jesus mind go know say Jesus go soon come and e go dey redi for Jesus.
-
253
Pikin dem mata - God word wen we dey take grow
Today we tork abat de tin dem wen David do wen come make bad tin dem happen to am to show say watin pesin sow naim e go reap tru-tru. De message of Hope say pesin wen get Jesus mind go dey happi to do eni tin wen God want make e do
-
252
Praya - God word wen we dey take grow
Today praya na God to epp us grow for hinside Jesus and make we get peace for hawa family. De message of Hope dey tell us say na differen kain mind dey dis world but God want make we get Jesus kain mind.
-
251
Praise - God word wen we dey take grow
Today fess song na "Blessed Assurance" and de sekond song na "Because He Lives" so as we get Jesus and Jesus dey, no shakin for we. De message of Hope say since we get Jesus and we dey forlow an waka, we don alredi get de life wen no dey end.
-
250
Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take grow
Watin fit make pesin kidni die and how we go manage bodi wen hawa kidni no go die naim bi today mata De message of Hope say beta kristian na pesin wen dey for war front and de war go end wen Jesus come so make we fite well so dat we go win
-
249
Pikin dem mata - God word wen we dey take grow
Today advise for hawa pikin dem na say as year dey start so make dem mind watin dem dey do bikos as pesin doam na so e go see am. De message of Hope say make we waka as Jesus waka so dat we go tru-tru bi beta kristian
-
248
Praya - God word wen we dey take grow
Today praya na for pipo wen dey sick, de ones dem wen dey for IDP Camp and de pipo wen devo dey worri. De message of Hope dey tell us say wen we bi beta kristian we go do de kain work wen Jesus do wen hin dey for here.
-
247
Praise - God word wen we dey take grow
Today fess song na praya make God hide us for de kross and de sekond song say make we bi like de kristian dem wen dey Bybbo De message of Hope say beta kristian na pesin wen dey learn how e go take waka as Jesus waka wen e dey dis world.
-
246
Woman dem mata - God word wen we dey take grow
De tin dem wen no dey make some woman kwik marray and watin dem fit do put naim bi today mata. Today message of Hope say wen we give Jesus hawa life, we go bi God pikin and we sorpose dey waka as God pikin for dis world.
We're indexing this podcast's transcripts for the first time — this can take a minute or two. We'll show results as soon as they're ready.
No matches for "" in this podcast's transcripts.
No topics indexed yet for this podcast.
Loading reviews...
ABOUT THIS SHOW
AWR Pidgin English
HOSTED BY
Adventist World Radio
CATEGORIES
Loading similar podcasts...